May 18, 2024
Lady Breaks Up With Her Boyfriend Over Wizkid Vs Davido Beef

As di tori go, one babe don waka comot from her bobo because e too dey kolo for di popular music star, Wizkid.

Dis mata dey happen for di middle of di yeye fight between Wizkid and im colleague, Davido.

For one post wey Famousblogng share for Instagram, di babe wey we no sabi her name carry her tori go WhatsApp DM of persin to yan wetin dey do am because of di wahala wey she just get with her bobo.

According to her, her bobo don dey too do magomago dey post about Wizkid and dey call am “Popsy,” wey na wetin hin fans dey always call am.

She dey wonder why her 27-year-old bobo go dey call another person “Popsy” when hin get papa for house.

Di babe chook mouth for di matter talk how dem dey discuss something and he go just switch enter Wizkid tori.

Di text wey she send read…
Lady Breaks Up With Her Boyfriend Over Wizkid Vs Davido Beef

“I just broke up with my boyfriend or I should say ex now and I pray I don’t go back to him I cant just imagine being with someone so stqpid He’s 27 and he’s doing fc fc up and
down since morning he has been posting Wizkid up and down with the caption popsy meanwhile he has a father its becoming annoying at this point sometimes if we’re having a serious conversation he will just cut in and say he doesn’t like stress and wants to be like his popsy, the obsession is becoming too ins•e abeg Africahotspot I don tiree”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *